OFFICER WHY? (Dedicated for the Justice of Joseph Pessu's murder in Warri over Covid-19 Lockdown) Naija, why e be say, We sabi copy wetin we no sabi paste? Lockdown wey pots dey para, belle dey cry; Awa gahment sabi sign paper for bullet To pushu belle wey no fit again, But to give kontiri man food chop Na bird wey get teeth. Kontiri man, I tink say na Coro we all dey fight? Why awa fellow brodas wey carry katapot, Dey silent us korokoro like Goliath, Without a Psalm of mercy for diya trigger? As e be so, Waffi dey para! Area don worwor! De ink for my pen don finish, Na my tears I dey take rait dis one. See, even de Devil wey dey inside me dey weep For de erosion of blood wey visit Warri... Officer why? Na Covid-19 born Honga-20, no be kontiri man... Officer why? Officer why? Which crime kontiri man commit Wey na kontiri man dey always be suya For all the Owambe Wahala for dis kontiri: Election come, kontiri na suya; Coro come, kontiri man na suya... Officer why? You sef na kontiri man oo, Forget dis katapot wey dem borrow oo... Officer why? #2WYTH #gbeduPoet #wakawakapoet #ph2eko #abrahamsjourneywith2wyth #warrination #OfficerWhy? #HungerPandemic #HongaDeyTown #WarriWeeps #Covid19 #Coro #WarriCovid19Killing #JusticeForJosephPessu #wafi #warri @aycomedian @mcabbeydaprof @officialbovi @i.go.die @igosave @osamacomedian @mofedamijo @official2baba @donjazzy @yadadi10 @ushbebecomedian @realwarripikin @warri_bros @warri_coolcats @dadaboyehiz @dsgovernment @muhammadubuhari @who @covid19updated @bbcnewspidgin @pidginradio1 @pidgin.insp @chiefotota @ovbeat101 @therealotb @pidginstreet #pidginpoem #CoronaTimesPoetry #coronatimes @ratatanation #josephpessu #josephpessumurder @errigapaperboy @victoradere #poemforjustice #speakforthemasses (at Lagos, Nigeria) https://www.instagram.com/p/B-f-vPOgz2h/?igshid=1b0ya9os51pj6